Search Anything On Nairaflaver

Music

Kunmie – Arike

download

Arike by Kunmie na one hot track wey don burst our Naija music scene and dey make everybody yan say, Omo, dis song no dey play ooo, Kunmie fit be the next Fireboy, But make una chillax make i yan small about dis song, and if you get any gist or your own reaction, feel free to drop your comments make we gist together.

Right from di start, we Nigerians no too sabi Kunmie, and na this Arike song be the one wey give Kunmie fame, the guy don use dis song to show say him sabi how to capture our attention. Di song na sweet mix of catchy chorus, clean production, and heartfelt lyrics wey dey make you feel say love dey sweet πŸ˜‚πŸ˜‚ Ehe na, nawa for you ooo brooooo.. ah go lie for you??? Guy the way the instrumental blend the drum and bass with one kind soft keyboard tones na one correct combo wey dey set di mood from start to finish.

Kunmie – Arike Lyrics

The lyrics of Arike by Kunmie no be just about sweet sound, them dey tell story too. For di song, Kunmie dey use soft but meaningful word to talk about love and how special di person wey dey attract im heart be. When he dey sing, “Fine girl, girl your body is enough, let me have it,” e be like say e dey praise di beauty and uniqueness of di person wey capture him attention. The lyrics dey simple but dem carry plenty heart and passion. Brooo the way he take yarn say if you no dey, di world go dey dull, that kind message dey touch everybody wey don ever fall in love.

ALSO READ:  [Music] Nsikak ft Show Dem Camp & The Cavemen – Dance 4 Me

How u dey feel when you hear di line? You don ever use di song take represent your own love matter? Abeg, make u sef yan me!

Arike By Kunmie TikTok Challenge

@afrosounds_villa

@Kunmie ARIKE OH AH πŸ™†πŸΎβ€β™‚οΈπŸ˜« #afrosoundsvilla

♬ original sound – Kunmie

Another thing wey make Arike by Kunmie dey special be say e don quickly become one media sensation. Social media platforms like TikTok and Instagram don dey light up with dance videos and reactions to di song. Many DJs don dey include dis track for their setlist, and na so e dey connect people from all corners of di Naija. Di interactive nature of di song dey encourage fans to create their own dance moves, share their versions, and even remix the track. Di community engagement wey dis song dey generate na clear sign say Kunmie don touch di hearts of many.

So, if you never jam Arike yet, no dull yourself o! Run listen am, and as you dey groove to di beat, remember say di song na celebration of love, life, and di power of good music.

Kunmie – Arike Mp3 Download

How una feel about di song? Una think say it dey capture the essence of modern Naija afrobeats? Make we yan more for here, download the song as music na one thing wey dey bring us together!

Please specify the URL of your file

Enjoy di vibe, stay blessed, and make sure say you share the love, Sha drop your reaction, share your dance moves, and let’s keep the conversation going.

Leave a Comment