Search Anything On Nairaflaver

Music

Venus – The Moment You Call

download

Una don hear the song wey them talk say The Moment You Call by Venus? E be that one track wey don burst brain for our Naija streets, and I sure say una go feel the groove once una jam am. Make we yan gist about the song and the way the lyrics dey hala well-well!

Right from di start, The Moment You Call dey burst enter your ear with one smooth afrobeats vibe wey be like say na pure energy dey flow. Di track get that catchy hook and rhythmic beat wey dey make you wan dance even if you dey house for chill mode. Venus sabi how to blend modern afrobeats with that classic Naija flavor, so di song no only dey enjoyable but e still dey remind us of our roots.

Venus – The Moment You Call Lyrics

Wetin really dey catch attention na the lyrics wey Venus drop. You go hear when he talk say:

And the moment you call
The moment you call, I’m showing up
If you wan see Joe Biden, then it’s my line you’re dialling
Merci beaucoup I’m buying, whatever you’re selling (lelele)

Shele no deny am o
Shele no deny am o
Shele no deny am o
Shele no deny am o

These lines na pure statement of confidence, When Venus yan “The moment you call, I’m showing up,” e be like say e dey tell everybody sey no matter wetin, e dey always ready to flex and make sure say him presence dey felt by him babe. And di line “If you wan see Joe Biden, then it’s my line you’re dialling” just burst brain with how e dey mix international gist with local gbedu, plus di repeated chorus “Shele no deny am o” na like warning say no one fit ever diss am or deny him the real vibe wey him.

ALSO READ:  Young M.A - No Mercy

The Moment You Call TikTok Challenge

Make i burst you thinking, the slang with international reference show say Venus dey try bridge di gap between Naija and di world. So tay even them korean dey use am do challenge for tiktok, na why them also dey talk say, no matter where you dey from, if you get good music and you dey ready to shine, your song fit reach anywhere. We know say na pure humor with one serious undertone venue been use sing the song, e come be like love songs. See one tiktok video of the song challenge from one elderly man πŸ˜…πŸ˜…

@funshoadeolu

♬ original sound – LYRICSLOUNGE🎡

Oya, swear say u no like am? πŸ˜‚πŸ˜‚ venus dey encourage everybody to live their life full of passion, confidence, and without fear. As we dey hustle everyday, sometimes, we need small reminder say our energy matter pass any small palava.

Venus – The Moment You Call Download

To sum up, The Moment You Call by Venus na one track wey dey burst head and na pure Naija vibe. So make i no dull you bcz them say too much talk no dey full basket πŸ˜‚πŸ˜‚ and make una no dull una selves, run listen to di song, groove to the rhythm, and join di movement. As di chorus yan Shele no deny am o.

 

How una dey feel when una hear di chorus? Drop your comments make we gist small!

13 Comments

Leave a Comment